Wia dis foto come from, Getty Images
Canada don introduce new rules wey go affect temporary residents for di kontri sake of say dem wan protect dia borders and immigration system.
Dis new rules dey come afta several immigration policy wey dey intended to reduce di number of pipo wey dey apply to stay for Canada.
According to di Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC), di new rules go empower immigration officials to fit cancel temporary residents documents under some circumstances.
Dem tok say dis cancellation go include electronic travel authorization (eTAs), work and study permit, temporary resident visas (TRVs).
For February 12, 2025, IRCC announce di Immigration and Refugee Protection Regulations wey also be di cancellation of Immigration documents.
Di regulations say officer get reasonable grounds to believe say any foreign national no go comot for Canada by di end of di period wey dem authorize for dem to stay.
Meanwhile, Canada say dem dey welcome individuals from kontris all ova di world wey wan study, visit or even work but dem gatz comply wit di eligibility requirements under di Immigration and Refugee Protection Act and Regulations.
Canada add say all temporary residents gatz get a TRV or eTA so dem go fit enta di kontri and dose wey wan study or work gatz get permit.
All dis documents dey important to study for Canada unless di Immigration exempt pesin and now, officials get di power to act wen issues about temporary documents come up.
On di oda hand, Canada say dem dey expect “approximately 7,000 additional cancellations of temporary resident visas, work permits and study permit documents”.
Dis new rules go affect international students for Canada and even dose wey just wan apply for di new year.
Meanwhile, Canada bin officially set to issue 437,000 study permits for international students applications in 2025.
Dis na part of how dem wan reduce international students numbers, but wit dis new rules, Canada immigration officials go fit cancel some permits under certain circumstances.
Dis dey come afta report show say about 50,000 international students wey apply for study permit for Canada to get higher education no show for di school wey dem apply to.
For January 2025, according to di goment data from spring 2024, di number of dose wey dey affected reach 50,000 from kontris like Nigeria, Rwanda, Ghana, Iran among odas.
Di data show say na India and China be di kontri wey dey top di list of di kontris wey get di highest number of non-compliant student applicants wey no show up for di schools wey dey suppose enrol into.
However, dis new rules go affect even students wey no get di correct residency documents wey fit allow dem stay for Canada and dose wey dey stay illegally.
Wia dis foto come from, Getty Images
According to Immigration and Refugee Protection Regulations, IRCC tok say di ground wey go make officials cancel temporary visa include:
According to di new rules, pipo wey go dey affected include students wey dey apply for study permit for Canada.
Di cancellation of temporary Canadian study permit fit be sake of administrative errors or if di pesin dia.
“Officer fit cancel a study permit wey dem issue to a foreign national if di officer dey satisfied say di study permit dey issued based on administrative error, or if di foreign national die.”
Di new rules go also affect dose wey get work permit for Canada and immigration fit cancel di temporary visa.
“Work permit go dey invalid wen e expire or wen e dey cancelled or if di officer dey satisfied say di work permit dey issued based on administrative error or di pesin die.”
Dose wey dey visit for oda purposes go dey affected also if dia documents no complete, dem die or na administrative error dem use get di temporary visa.
Di impact of dis new changes on foreign nationals dey expected to dey small but di cancellation don alreadi dey happun.
Dose wey dey affected by dis new rules go face di following: